45 But if dat savant tink for en mind sey, ‘My oga go tey small and e bigin beat di oda savants, weda na man or woman; e kon dey chop, dey drink anyhow,
I don already know how I go take ponish dem and dem don rite di way dem go take die for groun. I nor go look wetin dem don do kon trowey face, but I go pay dem back
As long as I bi di God wey nor dey die, e go betta for una if una listin to mi. Wiked animals attack my sheep kon kill and chop dem, bikos dem nor get who dey guide dem. My shepads nor even try to look for di sheep, instead na diasef dem kare about.
“Wen pesin dey do party, na betta wine e dey first serve pipol, den wen di pipol don drink taya, naim e dey serve cheap wine. But yu kon keep di good wine until di party don one finish.”
Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.
For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).
Dem go sofa for dis tins wey dem dey do, bikos dem feel sey dem fit do anytin wey dia body wont for day time and wen ever dem follow una chop, dem dey kause trobol among una.
Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.