28 Den Jesus sey, “Pipol wey hear God word and do wetin e tok, na dem God don bless!”
Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am.
Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand.
Keep God kommandment and yu go get long life; but yu go die, if yu nor follow dem.
So, make yong pipol listin to mi naw kon do wetin I tok and dem go dey happy.
Jesus ansa, “My mama and brodas na pipol wey dey hear and obey God word.”
Since una know wetin I dey tok, God go bless una, if una do dem.
Di pesin wey go read dis profesy give pipol, God go bless am. God go bless doz wey dey listin and do wetin dem rite for di profesy, bikos di time don near.
God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.