Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Luke 1:69 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

69 E send di Savior wey get pawa kom meet us, from David family.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Luke 1:69
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na God dey protet and save mi. Na-im bi my shield and E dey defend mi. E dey protet and save mi from danger.


Dem go know yor name and pipol go tok forever sey, ‘God Almighty na Israel pipol God’ and Yu go always dey protet my kingdom.


But I nor go take di whole kingdom from am. Instead, I go leave one tribe for am bikos of David, my savant and bikos of Jerusalem, di town wey I dey stay.”


Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.


Na Yu bi dia strent and glory and e dey sweet Yu to make us strong and bikos Yu favor us, wi dey always win.


God sey, “I don make kovenant with David, my savant wey I choose. I don promise am sey:


Dem go serve mi wey bi di Oga dia God and na one of David shidren-shidren, go bi dia king.


“Wen dis tins happen, I go make Israel pipol strong and yu, Ezekiel, go tok for where evribody go hear yu, so dat dem go know sey na mi bi God.”


God sey, “For dat day, I go ribuild David kingdom wey fall. I go ripair en fence kon build am back. I go build am again kon make am bi as e bi before.


Jesus Christ wey dem born for David and Abraham family, naim story bi dis.


God don bless awa papa David kingdom wey dey kom. Hosanna, wi hail o-o!”


“Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”


Hannah kon pray dey sey, “My heart dey happy bikos of God; I dey blow my trumpet loud for God. I dey shaut and happy, bikos God don disgrace and save mi from my enemies.


God go skata en enemies; E go skata dem with tonda from heaven. God dey judge di world from biginnin go rish di end. E go give en king pawa kon honor di one wey E anoint.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ