Yu go take some of en blood kon put am for di four horn, di korna for di altar, di one for middle and round di korna dem. Like dis, yu go klean di altar kon make am dey holy.
Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar.
Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar.
Dis na true, bikos na from am and thru am evritin take kom dis life, so dat salvashon go dey korrect thru en sofa and e go karry many pipol enter en glory.