14 E wosh di intestine and di leg kon burn dem for di altar on-top di remainin burnt ofrin.
Make una nor chop raw or meat wey dem boil, but make una roast am for fire well-well with en head, leg and all di parts for en body.
Afta Moses don wosh di intestine and di leg with wota, e kon burn all di ram on-top di altar as komplete ofrin. Na burnt ofrin wey dem give to God and God like am well-well. So, Moses do as God kommand am.
Dem give Aaron di head and di oda pieces for di animal and e burn dem for di altar.
Afta, e kon do ofrin for di pipol. E take di goat wey dem give for di pipol sin kon kill-am and e first do en own sin ofrin.