32 But make una burn di meat and bread wey remain.
Una must chop evritin finish before day break kon burn anytin wey remain for morning.
And if any of di ofrin meat or di bread remain till morning, den yu go burn wetin remain with fire. Nobody must chop am, bikos e dey holy.
Make yu nor boast about tumoro, bikos yu nor know wetin go happen between naw and den.
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
But dem must burn di meat wey remain for di third day.
Una nor go komot from di tent gate for seven days, until evritin wey dem go do for una ordinashon, don finish.
Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon!