Den yu go kill-am, take some of en blood put for di korna for di sons rite ear, di first big finger for dia rite hand and di big toe for dia rite leg, den sprinkol di blood round di altar.
Make yu take some blood wey dey di altar and some anointin oil, den sprinkol dem for Aaron and en sons body, so dat Aaron and en sons with dia garments, go dey holy.
Den di priest go take some blood for di lamb kon put am for di pesin wey dem dey santify rite ear; en big finger for en rite hand and en big toe for en rite leg.
E go take some oil wey dey en hand and some blood for di lamb kon put dem for di pesin wey dem dey santify rite ear; di big finger for en rite hand and di big toe for en rite leg.
E go put some of di oil for di same place just as e put di blood before for di pesin rite ear, di big finger for en rite hand and for di big toe for en rite leg.
My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
(I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.
To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.
Di hope wey I get bi sey, shame nor go ever fit katch mi; my heart go strong well-well and as I dey do naw, na so I go always dey do. Evritin for my body go praiz Christ, weda I dey alive or I don die.
Dis na true, bikos na from am and thru am evritin take kom dis life, so dat salvashon go dey korrect thru en sofa and e go karry many pipol enter en glory.