22 Den Moses bring di sekond ram wey dem go use take anoint di priests, den Aaron and en sons put dia hand for di animal head.
Dis na di law for di burnt, korn, sin, guilt, ordinashon and di peace ofrin.
“Make yu take Aaron and en sons go di tent gate, bring dia garments, di anointin oil, di yong melu for di sin ofrin, di two ram and di basket of bread wey nor get yist.
Den Moses take di breast kon gi-am as special gift to God. Na Moses own part for di ordinashon ram, bi dat. Moses do all wetin God kommand am.
I don separate mysef from di world for dia sake, so dat dem go fit separate diasef from di world too.
Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;
Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.
Husband, make una love una wife, just as Christ love di church kon sakrifice en life for am,
E do like dis, so dat di church go bi like wife wey fine well-well, wey nor get any stain, dey do anyhow or get any oda tin wey fit spoil am.