Yu and yor family go fit chop di breast and di leg wey dem give as special gift and di special kontribushon wey dem give God. Yu go fit chop am for any place wey dey holy. Na yu and yor sons get dis ofrin, bikos na part of di peace ofrin wey Israel pipol give.
Di animal breast na special gift and di rite leg na special kontribushon wey God don take from Israel pipol kon gi-am to di priests. Dis na wetin Israel pipol go give di priests forever.
Den, di priest go give dem as special gift to God; na holy ofrin for di priest, with di ram breast and leg, bikos na di priest own akordin to wetin dem rite for di law. Afta dis, di Nazirite go fit drink wine.’
Di tins wey di priests go take as dia own share, na di animals and oda tins wey di oda tribes bring kom as ofrin: dem go take di animals shoulder, jaw and belle.
So di pesin take di meat leg kon go put am for Saul front. Samuel kon sey, “Di food wey dem keep, na-im dey yor front naw o-o. Chop, bikos na yu dem keep am for since wen I sey, ‘Make una invite pipol kom.’ ” So Saul kon follow Samuel chop.