Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 7:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 E nor matter where Israel pipol dey stay, dem must neva use bird or animal blood take do food.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 7:26
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But make una nor chop meat wen en blood still dey inside am.


“Una go still do like dis for una animals; dem fit dey with dia mama for seven days, but una go give dem to mi for di eight day.


Naw, make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘Una dey chop meat with dia blood; dey woship juju and dey kill pipol. So wetin make una tink sey na una get di land?


“ ‘Una must nor chop anytin wey still get blood for inside. Una must nor do majik or serve juju.


“ ‘Make una nor ever chop any fat or blood and Israel pipol must obey dis law from one generashon go rish anoda.’ ”


Anybody wey chop animal wey dem offa as food ofrin to God, nor go dey among God pipol again.


Anybody wey break dis law nor go dey among God pipol again.’ ”


Jesus tell dem, “I dey tell una true word, unless una chop Man Pikin flesh and drink en blood, una nor go get life for inside una.


but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.


‘Wi advise sey make una forbid meat and blood wey dem don sakrifice give juju and any animal wey una kill wey en blood nor tosh groun. And make una nor sleep with who una nor marry.’ If una forbid all dis tins, una go do well!”


Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.


But una must nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.


But make una nor chop blood, bikos blood na life and una must nor chop animal blood with di meat.


But make una nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.


Bikos evritin wey God kreate, dey good and wi nor suppose rijet any food, so-far wi don tank God for am,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ