15 Dem must chop di meat for di same day wey dem sakrifice am; no meat must remain till di next morning.
Una must chop evritin finish before day break kon burn anytin wey remain for morning.
“Make una nor offa my sakrifice blood with bread wey get yist. And di animal fat wey dem sakrifice, must nor remain till di next morning.
If anybody tank God with dis ofrin, e go still bring bread wey dem nor make with yist: weda di bread strong or dem mix am with olive oil. E fit bi biscuit wey dem rub olive oil put or kake wey dem make with flower kon mix am with olive oil.
Instead, for evry year, una and una family go chop dem for di Oga una God present, for di place wey E choose.