Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 If anybody tank God with dis ofrin, e go still bring bread wey dem nor make with yist: weda di bread strong or dem mix am with olive oil. E fit bi biscuit wey dem rub olive oil put or kake wey dem make with flower kon mix am with olive oil.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 7:12
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Hezekaya tell dem, “Si, una don dey klean for God eye, so make una bring sakrifice and gift kom take tank God for en temple.” Den, evribody wey gada, karry sakrifice and gifts go tank God and anybody wey like to offa sakrifice, dey burn en ofrin.


E build God altar kon offa peace and tanksgivin ofrin. E tell Judah pipol make dem serve Israel God wey bi di true God.


For dat day wen pipol dey happy, dem offa many sakrifice, bikos God don give di pipol rizin to dey happy. Di wimen and shidren still join for di celebrashon and evribody from far know sey betta tin dey happen for Jerusalem.


So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem.


So I go tank God with sakrifice kon pray to am.


But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”


Una go hear am kon shaut with happiness, with joy and belle go sweet una wen una dey do marriage. Una go hear pipol dey sing as dem dey kom tank mi with dia ofrin. Dem go sey, ‘Make wi tank God wey dey mighty, bikos E good well-well and en love dey forever.’ I go make dis land prosper as e bi before. Mi, wey bi God, don tok.”


Make una turn kom meet God and pray to am sey: “Make Yu forgive us awa sin kon asept awa prayers, so dat wi go praiz Yu.


“ ‘If di ofrin na bread wey dem bake for oven, den dem must nor make am with yist. E fit bi tick bread or biscuit wey dem make with flower kon mix am with olive oil.


If di ofrin na bread wey dem kook for iron plate, dem go make am with flower wey dem mix with olive oil, but make e nor get yist.


Wen una dey offa tanksgivin sakrifice to God, una must follow di rule, so dat I go asept am from una.


Aaron and en sons go chop di remainin ones. Dem go take am make bread wey nor get yist kon chop am for di Holy Place where God Temple dey.


Dem must chop di meat for di same day wey dem sakrifice am; no meat must remain till di next morning.


Bread wey dem make with yist, una dey bring am as ofrin to take tank mi and dey karry body up bikos of di oda ofrins wey una give. True-true, dis na di kind tin wey una like to do.”


Dem go still give one basket wey bread wey dem nor make with yist full: kake wey dem make with flower kon mix am with olive oil and biscuit wey dem take olive oil rub plus di korn ofrin and di wine wey dem nid.


E fall face groun for Jesus front kon dey tank am. (Di man na from Samaria.)


Na only dis man wey bi strenja fit kom back kon praiz God?”


Even doh dem know sey God dey, dem nor dey gri gi-am glory as God. Dem nor dey tank am for all di tins wey E dey do. Instead, na nonsense tins dem dey do and dia wiked mind nor fit undastand di trut again.


With awa Oga God Jesus Christ name, make una dey tank God awa papa for each oda.


True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.”


So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ