Imnah pikin Kore, wey kom from Levi tribe, dey guide di east side for di temple and na-im still dey kollect and divide di gifts wey pipol bring kon give God.
For dis big room, four tabol dey der; two der for each side for di room. Na for dis tabol dem for dey kill di animals wey dem won sakrifice; weda dem won burn or sakrifice am for sin or as ofrin.
kon sey, “Dis na di place where di priest go boil di meat, wey dem go offa as sakrifice for sin ofrin and na der dem go for bake di bread too, so dat dem nor go karry anytin wey dey holy go outside di kourt kon kause trobol for di pipol by mistake.”
“ ‘But if di man nor fit bring two dove or pijin, e go bring one kilogram for flower as di sin ofrin. E nor go put any olive oil or incense join am, bikos na sin ofrin e bi, nor bi korn ofrin.
“Wen anybody disobey mi by mistake kon kommit sin as e nor obey God holy propaty, den e go bring guilt ofrin to God. Di ofrin must bi en own ram wey dey okay, or e fit use silva take buy betta one, just as dem dey measure am with di Tabanako shekel.
“ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin.
“Make yu tell Aaron and en sons sey, ‘Dis na di law for sin ofrin. For di place where dem take kill di animal for di burnt ofrin for di nort side for di altar, na der dem go still take kill di animal for sin ofrin. Dis ofrin dey holy to God.
and e go give ensef back to God as Nazirite. Di time wey e make ensef unklean, nor mean anytin again. E go bring one year man lamb kom as ofrin to pay for en sin.