Pesin wey nor dey play pipol wayo or tif from pipol. Anytin wey pesin gi-am, so dat e go borrow di pesin money, e dey riton am give di pesin; e dey give food to pipol wey dey hongry and doz wey dey naked, e dey give dem klot wear.
for ezample, if e riton di propaty wey e take from pesin, bikos e borrow am money or give pipol back wetin e tif from dem kon stop to sin, den bigin follow di law wey dey give life, e nor go die and e go get long life.
Before dem go-go di kourt for outside where pipol dey, dem go first pul dia klot wey dem wear take work inside di temple kon leave am for di holy rooms. Dem go wear anoda klot, so dat dia holy klot nor go tosh pipol.
Wen dem wont pesin land, dem go dey find how dem go take seize am and wen dem wont pesin house too, dem dey take am by force. Dem dey opress, shit and take pipol propaty.
Una sey, ‘Si! E too hard to serve God!’ So una nor gri obey my kommand again. Naw, make una tink am sef, e good as una dey bring animal wey una tif; di ones wey dia leg break or wey dey sick, kom give mi as sakrifice? Una tink sey I go asept am from una?