Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 6:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 “Make yu tell Aaron and en sons sey, ‘Dis na di law for sin ofrin. For di place where dem take kill di animal for di burnt ofrin for di nort side for di altar, na der dem go still take kill di animal for sin ofrin. Dis ofrin dey holy to God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 6:25
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di man kon tell mi, “Dis two buildings wey face di open space so, dey holy. Na for inside dem, di priest wey dey enter God present, for dey chop di ofrin wey holy pass. Bikos di rooms dey holy, di priests go put di ofrin wey holy pass for der: di korn wey dem sakrifice for sin or for ofrin.


E go kill-am for di nort side for di altar and di priest go put di animal blood for di four side for di altar.


“ ‘If na burnt ofrin from en animals, e must bring man own wey dey okay kom Tabanako, so dat God go asept am.


Den e go kill di animal for der and di priests wey bi Aaron sons go give God di blood kon put am for di four side for di altar wey dey for di tent gate.


Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own,


E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin. Dis na di ofrin wey dey remove sin from pesin body.


E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin.


Dem must nor make di bread with yist. I don gi-am to dem as gift. E dey holy well-well like di one for sin and guilt ofrin.


Di men among di priest family fit chop dis ofrin, bikos e dey holy.


Dis law na di same for both sin and guilt ofrin: na di priest wey sakrifice am get di meat.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ