Den e go kill di man lamb for di place where dem for dey kill lamb for sin and burnt ofrin. E must do dis tin, bikos na di priest get di sin and guilt ofrin and dem dey holy.
“Make yu tell Aaron and en sons sey, ‘Dis na di law for sin ofrin. For di place where dem take kill di animal for di burnt ofrin for di nort side for di altar, na der dem go still take kill di animal for sin ofrin. Dis ofrin dey holy to God.