23 Dem nor go chop any part for di korn ofrin wey di priest make; dem must burn all of dem finish.”
“Di melu and di goat wey dem use for di sin ofrin, so dat Israel pipol go dey klean from sin, dem go karry dia blood go di place wey holy pass kon burn dem for outside. Dem go burn dia skin, meat and intestine.
Di remainin ofrin na di priest own; e dey holy, bikos dem take am komot from di food ofrin wey dem give God.
den karry dem go outside di kamp for where dem dey pour ash put, den e go burn dem for der with firewood.
E go karry di melu go outside di kamp go burn am, just as e take burn di melu wey e give for en own sin.
Den di High Priest go take some of di melu blood kon karry am enter di tent.
Di priest wey go take-ova from Aaron among en sons, go always dey do am. Na God get am and dem go burn am komplete. Dis law na forever.
Den God tell Moses: