Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 6:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Dem must nor make di bread with yist. I don gi-am to dem as gift. E dey holy well-well like di one for sin and guilt ofrin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 6:17
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For seven days, yu go make sakrifice for di altar kon santify am, den di altar go dey holy and anytin wey tosh di altar, go dey holy too.


Den yu go anoint di altar for di burnt ofrin with all en tins kon santify di altar and e go bi di altar wey dey holy pass.


Moses ask for di goat wey dem take do sin ofrin, but dem tell am sey dem don already burn am. E vex for Eleazar and Itama kon ask,


“ ‘Make una nor give God korn ofrin wey dem make with yist; una must nor make di food ofrin wey una go give God with yist or honey.


Di remainin korn ofrin na di priests own; e dey holy, since dem remove am from di food wey dem give God.


“Make yu tell Aaron and en sons sey, ‘Dis na di law for sin ofrin. For di place where dem take kill di animal for di burnt ofrin for di nort side for di altar, na der dem go still take kill di animal for sin ofrin. Dis ofrin dey holy to God.


Di priest wey sakrifice di animal go chop am for di Holy Place inside God Temple where dem for dey meet.


Di men among di priest family fit chop dis ofrin, bikos e dey holy.


God still tell Moses, “Dis na di law for guilt ofrin and e dey holy.


Anybody wey kom from di priest family fit chop am. Dem must chop am for di Holy Place, bikos e dey holy.


Dis law na di same for both sin and guilt ofrin: na di priest wey sakrifice am get di meat.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ