Levitikus 5:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
7 “ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin.
“ ‘Wen dem don santify am finish, weda na boy or girl e born, e go-go di tent wey dem for dey meet go give di priest one lamb wey bi one year for burnt ofrin and one pijin or dove for sin ofrin.
“ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ”
“ ‘But if di man nor fit bring two dove or pijin, e go bring one kilogram for flower as di sin ofrin. E nor go put any olive oil or incense join am, bikos na sin ofrin e bi, nor bi korn ofrin.
Di priest go offa one as sin ofrin and di oda as burnt ofrin, bikos e go near dead body, den afta di ofrin, e go dey klean. For dat same time, en hair go dey holy again
Den Jesus enter di temple aria kon drive all di pipol wey dey buy and sell inside di temple, e skata di tabol and chair wey di pipol dey take shange money and sell dove.