Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 4:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 4:35
40 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ”


E go put di remainin oil wey dey en hand for di pesin head. Na like dis di priest go take make di pesin dey holy for God eye.


E go let di bird wey dey alive fly go outside di town for di open field. Na like dis di priest go take santify di house and e go dey klean.


Di priest go offa one for sin ofrin and di oda one for burnt ofrin. Na like dis di priest go take make sakrifice for di man for God eye.


and di priest go make sakrifice for am for di sin wey e kommit.


E go do di same tin with dis melu as e bin do with di melu wey dem use for di High Priest sin ofrin. Na so e go take sakrifice for di pipol and God go forgive dem.


E go burn all di fat for di altar, just as e take burn di fat for di animal wey dem kill take do peace ofrin. Na so di priest go take do di sakrifice for di leader wey sin and God go forgi-am.


Den e go offa di sekond bird as burnt ofrin akordin to di law. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.


As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man. Di remainin flower na di priest own, just as e bi for korn ofrin.’ ”


Den e must bring woman goat or sheep kon give God as ofrin for en sin. Dis na sin ofrin wey di priest go take klean am, so dat God go forgi-am.


As di priest offa dis sakrifice, di man go dey good for God eye again and God go forgi-am.”


Den Moses tell Aaron, “Make yu go di altar go offa di sin ofrin and di burnt ofrin, so dat God go forgive una and di pipol. Make yu do di ofrin for di pipol, so dat God go forgive una just as E don kommand.”


Den di priest go do di sakrifice for di kommunity and I go forgive dem, bikos dem nor sin from dia mind and dem don bring dia ofrin; ofrin wey dem make with God fire and ofrin to klean demsef for God present, bikos of di sin wey dem nor kommit from dia mind.


Di priest must do di sakrifice for di pesin wey kommit di sin, den I go forgi-am.


Since Jesus Christ kom, di law nor get pawa again and anybody wey bilive God, go dey raitious.


Na awa sins make God give Jesus Christ to dem make dem kill-am and God raiz am from deat, so dat e go make us raitious pipol.


So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ.


Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.


Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.


Dis na di pikin wey pay for us, so dat wi go dey free and God go forgive us awa sins.


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Jesus wey bi God Pikin, na-im bi awa High Priest wey don go heaven. Make wi hold am tait and always dey bilive am.


Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven


wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.


E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.”


Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


and na en ensef bi di sakrifice wey God nid to forgive us awa sins. Nor bi only awa sin, but di sin wey di whole world dey kommit.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ