Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 4:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 E go karry di melu go outside di kamp go burn am, just as e take burn di melu wey e give for en own sin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 4:21
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

All di pipol wey kom back from Babilon bring ofrin wey dem won sakrifice give Israel God. Dem offa 12 bull for Israel pipol, 96 ram and 77 lamb; dem still offa 12 goat to klean demsef from sin. Dem burn all dis animals as sakrifice give God.


But di melu flesh, en skin and en shit, yu go-go burn dem outside di kamp.


For di first day wey di festival start, di prince wey dey rule go offa one melu as sakrifice for en sins and for di pipol sins.


“Afta dat one, e go kill di goat for di sin ofrin for di pipol, take di blood go di place wey holy pass kon rub am for di plate and di Kovenant box front, just as e do di melu blood.


E go put en two hand for di goat head kon konfess all Israel pipol evil, sin and sturbones for di goat head, den drive am go di wildaness.


“Di melu and di goat wey dem use for di sin ofrin, so dat Israel pipol go dey klean from sin, dem go karry dia blood go di place wey holy pass kon burn dem for outside. Dem go burn dia skin, meat and intestine.


“ ‘If na Israel pipol kommit sin by mistake kon break one of God kommand and dem nor know, dem still don sin bi dat.


E go do di same tin with dis melu as e bin do with di melu wey dem use for di High Priest sin ofrin. Na so e go take sakrifice for di pipol and God go forgive dem.


Den e go shange en klot kon take di ashes go one klean place for outside di kamp.


Dem nor go chop any part for di korn ofrin wey di priest make; dem must burn all of dem finish.”


E take di remainin melu part, en skin, flesh and intestine kon go burn am outside di kamp, just as God kommand am.


den if una do anytin wey nor kom from una mind and di kommunity nor know about am, di kommunity must give one yong melu as burnt ofrin to take klean demsef.


just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”


Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.


Di High Priest dey karry animal blood enter di Holy Place as ofrin for sins, but di animal body, na outside di kamp dem for dey burn am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ