Levitikus 3:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
2 Di man go put en hand for di animal head kon kill-am for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin. Den Aaron sons wey bi priests, go rub di blood for di altar four side
Una go put una hand for di animal head kon kill-am for where dem for dey do meetin for di tent door-mot. Di priest go rub di blood for di altar four side
“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.
“But make yu nor take money for di first-born for melu, sheep or goat, bikos dem dey holy. Yu must kill and sprinkol dia blood for di altar kon burn dia fat for di ofrin wey dem make with fire wey get betta smell to God.