Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 3:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Den di priest go burn dem for di altar as food ofrin to God and God like am well-well. All di fat na God own.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 3:16
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

While Abel bring some of di first-born for en animals wey fat pass. God like wetin Abel bring,


Dem do many burnt sakrifice with di drink ofrin too kon burn di fat for di peace ofrin.


Solomon santify di kourtyard centre wey dey God Temple front. Di burnt sakrifice, di korn ofrin and di fat part for di peace ofrin, e offa dem for der, bikos di bronze altar wey Solomon make, too small to kontain all di ofrins.


Di fat wey dey inside di intestine; di part wey dey di liver top; di two kidney and dia fat, make yu take dem follow Aaron and en sons, den yu go burn dem for di altar.


“Since dis na di ram to take santify Aaron and en sons, yu go remove di fat for di tail, di fat for di intestine; di fat for di liver and di fat for di kidney. Yu go still remove di fat for di rite leg from di knee go up.


Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice, so dat God go forgive pipol dia sins. So en days go long and e go si en shidren-shidren and thru am, God go do wetin E wont.


God wey get pawa sey, “All di priests from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren must kontinue to serve mi, even wen all di odas for Israel nor gri serve mi again. So naw, na dem go serve, enter my present kon offa di animals and di blood for di sakrifice, give mi.


Di priest go pour di blood for God altar for di tent kon burn di fat and God like dis ofrin smell.


E go burn all di fat for di altar, just as e take burn di fat for di animal wey dem kill take do peace ofrin. Na so di priest go take do di sakrifice for di leader wey sin and God go forgi-am.


E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.


E take di fat (di fat tail, all di fat wey dey di intestine), di best part for di liver, di two kidney with dia fat and di animal rite leg.


At wons, God send fire go burn di burnt ofrin and di fat dem for di altar. Wen di pipol si am, dem kon shaut and bow face groun.


Jesus ansa, “Make pesin love God with all en heart, with all en soul and with all en mind.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ