Dem don dirty my temple, bikos dem dey allow pipol wey neva sekonsaiz enter. Pipol wey nor dey obey mi dey enter di temple wen dem dey offa animal give mi as sakrifice. So my pipol don break di kovenant with all dis yeye tins wey dem dey do.
Dis na how una nor take dey respet mi: una dey offa yuzles food for my altar, yet una still dey ask, ‘How wi nor take dey honor yor name?’ I go tell una. Una sakrifice show sey una nor dey respet my altar at-all.
Like dis too, for seven days, make una give God food ofrin, di smell wey E dey like well-well. Make una give all dis ones, plus di evriday burnt and wine ofrin.