34 Dis na di kommand wey God give Moses for Mount Sinai and na for Israel pipol.
All dis na di law and kommand wey God give Moses for Mount Sinai about Israel pipol.
For Mount Sinai, God kon give dis kommand to Moses for di day wey e tell Israel pipol to give dia ofrin.
God kon tell Moses for di place where dem for dey do meetin for Sinai Wildaness, for di first day, for di sekond mont for di sekond year, afta dem don komot from Egypt:
Dis na di evriday burnt ofrin wey dem go first give for Mount Sinai as dia food ofrin, bikos na betta ofrin e bi to God.
Dis na both Aaron and Moses family afta God tok with Moses for Mount Sinai.
Dis na di rule and laws wey God give Israel pipol thru Moses for Moab land opposite Jordan River for Jeriko.
Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.
Forty years afta Israel pipol don komot Egypt, for di first day for di elevent mont, Moses kon tell Israel pipol evritin wey God kommand am.
Dis na di kovenant wey God kommand Moses sey make e make with Israel pipol wen dem dey Moab, plus di kovenant wey E make with dem for Mount Sinai.
All dis na di law, rules and kommand wey Moses tell Israel pipol afta e don lead dem komot from Egypt
Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.