Shepad go kount dia sheep again for all di towns wey dey di hill kountry; di valley; Judah sout; Benjamin land; di village wey round Jerusalem and all di town for Judah. Mi, wey bi God, don tok.”
Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.