Levitikus 27:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English30 “ ‘One out of evry ten tin for wetin grow for di land, weda na grain or fruit, go bi God own. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
Dat day, dem kon pick men wey go dey guide di store room for di ofrins, di first part for di harvest and one out of evry ten tin wey dem give God. Na dem dey kollect money from di field outside di town and di part wey di law give di priest and Levi pipol. All di pipol for Judah dey happy, bikos of di work wey Levi pipol and di priests dey do.
“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey give one out of evry ten tins wey una get, but una nor dey do di important tin wey di law tok, wey bi to give korrect judgement, to trit pipol well and to do wetin dey good! Una suppose to dey do dis tins join di oda one.