Na like dis una go take make di nomba fifty year dey holy and una go free evribody wey dey stay for di land. For dis year, all di propaty wey dem don sell before, dem go gi-am back to di owner or en relashon. And anybody wey dem sell as slave, go-go back to en family.
But if di pesin nor get plenty money to buy di land back, di land go dey with di man wey buy am till di year wey dem go riton di land. For dat year, e go riton di land give di owner.
But house wey dey for di village wey nor get wall, dem go trit dem like field; di first owner for di house get di rite to buy di house back and dem go riton am for di year wey dem dey riton propaty.
Anytin wey God sey E go judge, una must nor take am at-all. Den God nor go vex again, but E go sorry for una kon make una plenty as E promise una grand-grand papa.
Di town plus evritin wey dey inside go bi God own, escept Rahab wey bi ashawo and evribody wey dey with am for inside en house, bikos e hide awa pipol wey go spy di town.