18 If e dedikate am leta, di priest go kakulate di money akordin to di years wey remain before di next Sabat year, den e go reduce di prize.
e go pay di man wey buy di land di money wey go rish to kover di remainin years, before di year wey dem go riton di land.
“ ‘Wen pesin dedikate en house to God, di priest go fix di prize weda e good or bad and di prize go bi di final prize.
If e klean en field for di year wen dem dey free pipol, den di land go bi di normal prize.
If di pesin wey dedikate di field won buy am back, e must pay di prize kon add twenty percent join.
di priest go kakulate di money akordin to di nomba of years wey remain before di next Sabat year and di pesin must pay di money for dat same day; na God get di money.