Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 27:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 If e klean en field for di year wen dem dey free pipol, den di land go bi di normal prize.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 27:17
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na like dis una go take make di nomba fifty year dey holy and una go free evribody wey dey stay for di land. For dis year, all di propaty wey dem don sell before, dem go gi-am back to di owner or en relashon. And anybody wey dem sell as slave, go-go back to en family.


Una nor go plant for una farm or harvest di korn wey dey grow by ensef or gada di grape wey dey di land wey una nor kut.


“ ‘For dis year, all di land wey dem don sell, dem go gi-am back to dia owner.


Den for di tent day for di sevent mont, di day to forgive sins, yu go send somebody go blow di trumpet for di whole land for Israel.


“ ‘Wen pesin dedikate en house to God, di priest go fix di prize weda e good or bad and di prize go bi di final prize.


“ ‘If anybody dedikate one part of en field to God, di priest go fix di prize akordin to di nomba of seed wey dem go fit plant and e go bi ten silva for evry twenty kilogram for barley.


If e dedikate am leta, di priest go kakulate di money akordin to di years wey remain before di next Sabat year, den e go reduce di prize.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ