“ ‘If anybody dedikate one part of en field to God, di priest go fix di prize akordin to di nomba of seed wey dem go fit plant and e go bi ten silva for evry twenty kilogram for barley.
But animal wey nor klean, dem go fit buy en first pikin back for di normal prize kon add twenty percent join. If e nor buy am back, dem go sell am give anoda pesin for di normal prize.
Any holy tin wey e spoil, e must pay back and e go add twenty percent give di priest and di priest go offa di animal as sakrifice for di sin wey di man kommit, den God go forgi-am.