And anybody wey make dis vow, nor go use anoda animal take replace am, weda na good for bad or bad for good. If e go use anoda animal, den di normal one and di ones wey e shange am to, go dey holy.
But animal wey nor klean, dem go fit buy en first pikin back for di normal prize kon add twenty percent join. If e nor buy am back, dem go sell am give anoda pesin for di normal prize.
Any holy tin wey e spoil, e must pay back and e go add twenty percent give di priest and di priest go offa di animal as sakrifice for di sin wey di man kommit, den God go forgi-am.