Na Joab broda, Abishai dey lead di three strong sojas. E use en spear take fight three hundred men kon kill all of dem, den e kon dey popula with di three strong sojas.
For dat time, God go protet doz wey dey stay Jerusalem and even doz wey weak pass among dem, go dey strong, just as David, dia grand-grand papa bi. David shidren-shidren go lead dem like God angel and dem go bi like God.
Make una nor dey sturbon to God and make una nor fear di pipol wey dey di land, bikos dem bi like bread to us. God dey with us and E don defeat di gods wey dey protet dem; so make una nor fear.”