Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 26:43 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

43 All di pipol wey dey di land must komot first, make e for get komplete rest and dem must pay di prize, bikos dem rijet my law and kommand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 26:43
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As dem dey sofa am, Manasseh kon turn go meet God wey bi en grand-grand papa God sey make E kon help am.


So, wetin God tok thru Profet Jeremaya kon happen. “Dem go abandon di land; di land go rest well-well until di seventy years don komplete just as God tok am.”


Na blessing dey follow di man wey God korrect! So make yu nor komplain wen God dey ponish yu for yor sins.


I bin dey sofa, bikos I waka live yor ways, but naw, I dey obey yor word.


My pains dey good for mi, bikos e dey tish mi how to listin to yor kommand.


My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard. Yu dey ponish mi, bikos e dey good for mi.


Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”


Una nor gri listin to my kommand, instead una dey do my word anyhow like dirty.


God, wen wi dey pass thru pain, wi kry, pray and look for Yu, bikos of di way Yu dey ponish us.


Before, wi sin against Yu, but naw, wi wons turn from sin kom meet Yu. Afta Yu ponish us, shame nor let us karry awa head up again. Di sin wey wi sin wen wi dey yong, dey make us dey shame.”


Awa Oga God dey ready to ponish us and E really ponish us, bikos anytin wey E dey do, dey rite, yet wi nor gri listin to am.


I go stay with una for inside my holy tent and I nor go ever komot for where una dey.


If una nor gri obey my law, kommand or keep di kovenant wey I make with una,


I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.


kon make mi turn against and give dem as slave to dia enemies. But wen una shidren-shidren honbol demsef and dem pay for dia sins and sturbones,


Una nor like anybody wey dey judge well or tok trut for kourt.


Na one mont I take kill di three oda shepad wey hate mi, bikos I nor like dem too.


Pipol like una, but dem nor like mi, bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good.


Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.


God go judge en pipol and E go shange en plan about en savant; wen E si sey dia pawa don vanish and nobody remain again, weda na slave or free pesin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ