E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”
God go pour wota put for di seed wey una plant and di groun go produce plenty food for una. For dat time, una animals go chop betta green grass for field.
I go let grass grow for evriwhere and I nor go trim di vine or use hoe dig di groun again, instead, I go let dirty kover am and rain nor go ever fall put again.”
Just as no one among di juju for dis nashon fit bring rain, na so too di sky nor fit make rain fall by ensef. So wi don put awa hope for yor hand. Na Yu bi awa God, bikos na only Yu fit do all dis tins.”
Nobody go wahala dem wen dem dey plant dia seed. Dia vine go get many fruits; di groun go produce food and rain go always dey fall for dem. I go give all dis blessings to my pipol wey remain.
God go send rain from en rish store kom meet una for di rite time and E go bless all di work wey una dey do. Una go dey give to many kountries, but una nor go ever borrow from dem.
My brodas and sistas, make una get patient till Christ go kom back. Tink how farmer dey wait for wetin e plant until e grow kon bring food wey dear and e dey wait with patient for am, until di first and di last rain go fall put.
Dis two men get di pawa to klose di sky, so dat rain nor go fall as dem dey profesai. Dem still get di pawa to turn wota to blood and to kause bad tins to happen for di eart.