24 I go turn kon ponish una seven times and e go worse pass di ones wey I ponish una before.
Yu dey pure to doz wey dey pure, but Yu show wikedness to wiked pipol.
God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.
To pipol wey get pure heart, Yu dey show dem as Yu pure rish, but to wiked pipol, Yu nor dey sorry for dem at-all.
but dem fight against am kon make am vex. So God kon bi dia enemy and E fight against dem too.
“So make yu profesai and klap yor hands togeda. Di swod go attack and kill pipol again and again. E go kill my pipol well-well.
“If afta all dis tins happen and una nor still obey mi, I go inkrease una ponishment seven times.
“If una kontinue to rijet mi and una nor gri obey mi, I go inkrease una ponishment seven times again.
I go turn against una. Bikos I dey vex, di ponishment wey I go give una go bad seven times pass di ones wey I give una before.
kon make mi turn against and give dem as slave to dia enemies. But wen una shidren-shidren honbol demsef and dem pay for dia sins and sturbones,