But dis na wetin God tok: “True-true, dem go release doz wey dey prison and dem go seize wetin strong men karry kom from war. I go fight with anybody wey fight with una kon save una shidren.
I go tell doz wey dey prison sey, ‘Make una kom out!’ And doz wey dey for darkness, ‘Make una kom enter lite!’ Dem go bi like sheep wey dey chop grass for hill.
Na like dis una go take make di nomba fifty year dey holy and una go free evribody wey dey stay for di land. For dis year, all di propaty wey dem don sell before, dem go gi-am back to di owner or en relashon. And anybody wey dem sell as slave, go-go back to en family.