Levitikus 25:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
5 Make una nor even harvest any korn wey grow on dia own wey nobody plant and make una nor gada di grape from di gardin wey una nor kut; bikos na di year wey di land dey rest.
Den Isaya kon tell King Hezekaya, “Dis na sign of wetin go happen. “ ‘For dis year and next year, yu go chop only food wey just grow on en own, but as from di oda year, yu fit chop from di tins wey yu plant.
Den Profet Isaya tell King Hezekaya sey, “Dis na sign of wetin dey happen. For dis year and next year, na food wey grow on en own, una go chop, but di year wey go follow dat one, una go plant and chop una food. Na so too una go plant vine and chop di grape.
Even doh una nor plant for una land dat year, di land go produce food for una, una slave, di men wey una hire to work for una, di strenjas wey dey stay for una land,