Levitikus 25:39 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
39 “ ‘If una fellow Israel pipol wey dey stay near una dey poor kon sell ensef for una to bi slave, una nor go make am do di work wey oda slaves dey do.
One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”
Wi bi Jew pipol too, awa shidren bi like dia own shidren. But wi sell awa shidren as slave give dem. Dem don sell some among awa dotas as slave. Wi nor get pawa or who go help us, bikos dem don take awa farms and vineyards from us.”
“But if na for day time dem kill di tif, di tif blood go dey who kill-am head. “Tif wey dem katch must pay evritin wey e tif. If e nor get anytin, den dem go sell am take pay for wetin e tif.