“Levi shidren go get special place for der and e go dey di sout-side near di priests. E go long rish nine mile kon wide like three and kwota mile for west; di measurement na di same from nort go rish di sout-side.
Di aria wey dem leave for God, must bi di best part for di land and make dem nor sell, shange am or gi-am to anybody. Bikos e dey holy and na God get am.
If Levi pesin sell one among di house for di town and dem nor buy am back, dem must riton am for di year wey dem dey riton propaty, bikos di house wey Levi pipol get for dia town, na dia permanent propaty among Israel pipol.