But if di pesin nor get plenty money to buy di land back, di land go dey with di man wey buy am till di year wey dem go riton di land. For dat year, e go riton di land give di owner.
But if e nor buy am back for dat year, e nor go fit buy am back again and di house go bi di pesin and en sons own; dem nor go riton am for di year wey dem dey riton propaty.