Hanamel wey bi yor papa broda Shallum pikin, go kom meet yu. So make yu buy en field wey dey for Anatot, for Benjamin land, bikos yu bi en klose relashon and yu get rite to buy am.
Doz wey dey sell nor go get dia money back wen dem still dey alive, bikos God vexnashon na for all of dem. All dis sinnas go die finish and nobody go remain.
But house wey dey for di village wey nor get wall, dem go trit dem like field; di first owner for di house get di rite to buy di house back and dem go riton am for di year wey dem dey riton propaty.
Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us.
Make una nor do wetin go make di Holy Spirit vex. Bikos na di Holy Spirit bi di mark wey God put for una body, so dat for judgement day, E go know doz wey E go save.