Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 25:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Wen una sell land to una fellow Israel pipol or buy from dem, make una nor do wayo.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 25:14
33 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Asa vex well-well for di profet, so e kon put am for prison. Dat time, King Asa still vex opress some pipol.


Yu go judge well for shidren wey nor get papa and mama and doz wey dem dey opress, so dat wiked pipol nor go ever treaten dem again.


Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.


If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.


If yu dey give rish pipol gift kon dey opress poor pipol make yu for get more money, yu go poor too.


Ruler wey nor get betta sense, go rule with wikedness. But pesin wey nor like lie, go rule tey.


Poor man wey dey opress oda poor pipol, bi like strong rain wey dey skata wetin pesin plant.


If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.


Nor sopraiz wen dem dey opress poor pipol or as bad judgement dey kover good judgement. Dis na bikos, di lowa ofisas must do wetin dia senior ofisas orda dem to do.


Make una learn to do good; make una make sure sey una dey judge well; make una help doz wey dem dey opress. Pipol wey nor get papa and mama, make una give dem wetin dem wont and make una help wimen wey dia husband don die.”


Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite; wey nor dey shit poor pipol, bikos e get pawa and wey nor dey take bribe, join doz wey kill pipol or join do bad tins,


Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.


Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.


But yu dey always tink and look for ways to use wayo take make plenty money. Na to kill innocent pipol and opress yor own pipol, yu dey always tink.


Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again.


Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem.


Una go fix di prize akordin to di nomba for di year wey di land go produce food, before di year wey una go riton am.


Make una nor play una fellow Israel pesin wayo, but make una obey di Oga una God.


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


Den some sojas kon still ask am, “Wot of us? Wetin wi go do?” E tell dem, “Make una nor use force kollect money from anybody hand or lie for anybody head and make una salari, rish una.”


Sisera, get 900 iron war horse and e opress and rule Israel pipol with wikedness for twenty years, before Israel pipol kon kry give God make E help dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ