Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 25:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Na like dis una go take make di nomba fifty year dey holy and una go free evribody wey dey stay for di land. For dis year, all di propaty wey dem don sell before, dem go gi-am back to di owner or en relashon. And anybody wey dem sell as slave, go-go back to en family.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 25:10
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make God dey with all of una wey bi en pipol as una dey go Jerusalem go ribuild di Oga wey bi Israel God house and na-im una go woship for Jerusalem.


Pipol wey dem dey opress, E dey judge dia kase well and dey feed doz wey dey hongry. God dey free pipol wey dey prison.


“Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.


I go tell doz wey dey prison sey, ‘Make una kom out!’ And doz wey dey for darkness, ‘Make una kom enter lite!’ Dem go bi like sheep wey dey chop grass for hill.


I just feel sey di time to save my pipol don rish and na di rite time to ponish dia enemies bi dis.


So all di pipol and dia leaders kon gri to free dia slave and nor sofa dem again.


God tok to mi afta King Zedekaya and Jerusalem pipol don make agriment sey make dem free


But if di prince wey dey rule give any of en land to en savants, e go bi di savant propaty until wen Freedom Year go rish, before e go bi di prince own again. Na-im and en son get en propaty dem forever.


Una nor go plant for una farm or harvest di korn wey dey grow by ensef or gada di grape wey dey di land wey una nor kut.


“ ‘For dis year, all di land wey dem don sell, dem go gi-am back to dia owner.


For dat time, en and en sons go leave una kon go back to dia family and to dia propaty wey dia grand-grand papa get.


If dem nor let am go like dat, en and en sons go dey free for di year wey dem dey riton propaty,


‘E go save us from awa enemy hand, so dat wi go fit take all awa heart serve am


Na God bi di Spirit and anywhere en Spirit dey, pipol go dey free.


Hagar bi like Mount Sinai for Arabia kountry and na di same with Jerusalem wey dey naw, bikos e dey inside der as slave with en pikin.


My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.


Make una live as free pipol and nor use una freedom as eskuse to do bad tins, but make una use am well as God savant.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ