Dem take evritin wey dem make with gold and silva: di small basin; di shako pans; di sakrifice blood basin; di ash kontaina, di lampstand, di burnt incense basin and di wine basin.
For evening, Aaron go lite am till morning for God present outside di curtain for di Kovenant Box front wey dey for di holy place. Dis law go dey forever.
Dia work na to kare for di box, tabol, lampstand, di altars and di tools wey di priest dey use for di Holy Place. Dia work na to kare for evritin wey dey dia list.
Di seven stars wey yu si for my rite hand, na dia sekret bi dis: Di stars na di angels for di seven church and di seven lampstand, na di seven church.”
So, make yu remember where yu from fall and turn from sin kom meet God, den bigin do di tins wey yu first dey do. If yu nor gri turn from sin kom meet God, I go remove yor lampstand from where e dey.