Dis na di law wey una go obey forever. Dem must do dis sakrifice wons for evry year to take santify Israel pipol from all dia sins.” So Moses do as God kommand am.
Make una nor chop any new korn, weda raw one or di one wey dem roast or bake to bread, until una don bring di ofrin kom meet God. Una shidren wey una go born go obey dis law forever and ever.
Dat day na Sabat Day, so una must rest and una must honbol unasef for di ninet day for di mont for evening and from dat evening still di next morning, una must respet di Sabat Day.”