Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Levitikus 23:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 “ ‘Una go work for six days, but di sevent day, na di day wey una suppose rest. For dat day, una nor go work, but una go gada woship God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Levitikus 23:3
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Moses ansa, “Dis na wetin God tok: ‘Tumoro na Sabat Day, so evribody must rest. Anytin wey una won bake or boil, make una bake and boil dem today and anytin wey remain, make una keep am till di next day wey bi Sabat Day.’ ”


Make una know sey na bikos God sey make una rest for Sabat Day naim make am dey give una doubol food for di sixt day. So make evribody stay en house; make nobody komot en house for di sevent day.”


“Una go work for six days, but make una nor work for di sevent day, so dat una melu, donkey, slave and strenjas wey dey work for una, go rest.


“Una go work for six days, but for di sevent day, una must rest; even if na wen una dey prepare una land to plant or harvest.


I go bless pipol wey always dey keep di Sabat Day and obey di kommand. I go bless doz wey nor dey do wiked tins.”


God dey tell di strenjas wey join en pipol, doz wey love and dey serve am well; wey dey keep di Sabat Day and dey faithful as dem dey keep en kovenant sey:


God sey, “If una keep di Sabat Day holy and una nor run follow wetin una wont dat day; if una value my holy day and honor am and una nor travel, work or tok yeye word for dat day,


Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.


But di oga for di sinagog vex sey Jesus heal pesin for Sabat Day, so e kon tell di pipol, “Wi get six days wen pipol suppose work, so make una kom make dem heal una for doz six days, but nor bi for Sabat Day.”


Den di wimen go house go prepare betta perfume. But for Sabat Day, dem kon rest as Moses Law tok.


Bikos na since awa grand-grand papa dem time dem don dey prish Moses Law for di sinagog for evry Sabat Day.”


On Sunday, God Spirit kon dey kontrol mi and from my back, I kon hear one loud vois like trumpet dey sey,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ