For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.
As I dey lead dem kom back, dem go dey kry, beg and pray make I forgive dem. I go guide dem pass where wota dey kon take dem pass strait road where dem nor go kick stone fall. I go do am, bikos na mi bi Israel papa and Efraim na my first-born.’ ”
“Di tent day for di sevent mont go bi di day to pray make God forgive una. Una go gada woship and una nor go chop anytin, but una go give ofrin to God.
Dat day na Sabat Day, so una must rest and una must honbol unasef for di ninet day for di mont for evening and from dat evening still di next morning, una must respet di Sabat Day.”
If anybody tosh wetin nor dey klean, (weda na human being, animal or anytin) den kon chop dis ofrin meat wey dem give God, dem go remove di pesin from di kommunity.”
“Go kommand Israel pipol sey, ‘Dis na di pipol wey una go remove from di kamp: pipol wey get diziz for skin, doz wey dey discharge and evribody wey nor dey klean, bikos e go tosh dead body.