20 Di priest go offa di bread and di two lamb as special gift to God. Dis ofrin dem dey holy.
Yu go put all dis tins for Aaron and en sons hand kon karry dem as special ofrin go give awa God.
Each family go bring two bread and dem go offa dem give God as special gift. Dem go make each bread with two kilogram of flower; bake dem with yist kon offa am to God as ofrin from di first korn wey dem harvest.
Una go offa man goat for sin ofrin and lamb wey bi two years for peace ofrin.
For dat day, una nor go do una evriday work, but una go gada togeda woship mi. Una shidren go dey obey dis law forever.
Den Moses take di breast kon gi-am as special gift to God. Na Moses own part for di ordinashon ram, bi dat. Moses do all wetin God kommand am.
“Na only God get Glory for heaven and eart, make peace and favor dey with evribody.”
So if wi don plant spiritual seed among una, e go dey too mush if wi ask for ordinary food and drink from una?
bikos na Christ bi awa peace. Na Christ make Jew and Gentile pipol bi one. E don break di wall wey divide and separate dem as enemies.
Di first share for una harvest, new wine, olive oil and di wool wey una kollect wen una dey shear di sheep, make una give dem to di priest.