16 Una must kount fifty days until di day afta seven Sabat Day don pass, den una go give God anoda new korn ofrin.
For di third mont, dem kon gada all wetin dem bring till di sevent mont.
Each family go bring two bread and dem go offa dem give God as special gift. Dem go make each bread with two kilogram of flower; bake dem with yist kon offa am to God as ofrin from di first korn wey dem harvest.
“ ‘For di first day wen una dey do di harvest feast, wen una dey give di ofrin for new korn to God, una go gada woship and una nor go do any work.
Wen Pentekost Day rish, di disciples kon gada for one place.